Mohbad autopsy report: US lab update on Mohbad postmortem sample, report on cause of Mohbad death - BBC News Pidgin (2024)

Mohbad autopsy report: US lab update on Mohbad postmortem sample, report on cause of Mohbad death - BBC News Pidgin (1)

Article information
  • Author, Adesola Ikulajolu
  • Role, Broadcast Journalist, BBC News Pidgin
  • Reporting from Lagos

Di National Medical Services, wey dey known as NMS Labs don confam say dem receive test samples of di late singer Ilerioluwa Aloba alias Mohbad.

Di lab say dem receive postmorterm samples wey dem identify as "as being from Mr. Aloba" (di late singer).

Mohbad die on 12 September 2023 and pipo tok different about di death of di 27-year-old artiste.

NMS Labs wey dey US confam to BBC News Pidgin through mail on 6 June 2024 say one of dia laboratories receive di test samples of di late Nigerian singer Mohbad.

Remember say BBC News Pidgin bin monitor how di body of Mohbad take comot from wia di police dig am out for Ikorodu come carry am go Lagos State University Teaching Hospital (Lasuth) for September 2023.

Skip Recommended articles and continue reading

Recommended articles

End of Recommended articles

On 21 September 2023, dem carry di body of late body to go do autopsy to know wetin kill am.

Di tok-tok pesin for Lagos State Police Command, Benjamin Hundeyin confam for X dat time to say ‘Exhumation completed’ - and dem dey await result.

On May 2024, different tori den spread say dia lab no receive any test sample of late Mohbad.

But di US labs confam say dem receive di postmortem samples of late Mohbad on behalf of di Lagos State DNA & Forensic Center.

According to NMS Labs, 'postmortem toxicology testing services go support di medical examiner and coroner community to examine autopsy specimens and e go fit identify di presence and quantity of therapeutic and illicit drugs and oda toxic substances wey fit don result to di death of an individual'.

Di lab wey don dey exist for ova 50 years say dem dey strictly follow 'forensic standards and use technology to provide results quickly' and get a total of six laboratories for Pennsylvania, Florida and four oda places.

  • MohBad father speak about di death of im son and dia relationship
  • Mohbad wife reply tori say court wan order for DNA test
  • True tori of how MohBad die - Police reveal five 'key suspects'

'We complete testing of Mohbad samples'- NMS Labs

Mohbad autopsy report: US lab update on Mohbad postmortem sample, report on cause of Mohbad death - BBC News Pidgin (2)

Wia dis foto come from, @IAMMOHBAD/INSTAGRAM

Di lab exclusively admit say one of dia agent bin send informate in May 2024 wey give di impression say dem no get di samples from di late singer Mohbad.

“Unfortunately, in May 2024, an NMS Labs Customer Service Agent bin send one email wey give di impression say NMS Labs no get di samples from di singer Ilerioluwa Aloba, alias Mohbad,” di lab tok.

However, NMS Labs say dem don get approval to say dem receive di samples of late Mohbad from Lagos State through one of dia separate lab wey dey Pennsylvania named as ITSI Biosciences.

“ITSI Biosciences bin dey requested to complete a testing on behalf of di Lagos State DNA and Forensic Center and di Lagos State Attorney General office” di US-based labs confam.

According to NMS Labs through di mail reply wey dem send, na ITSI Biosciences come forward di samples give dem for testing.

Di lab say dem don complete di testing ontop di samples of Mohbad wey di Lagos state forensic center bring and dem don give report since April 2024.

“NMS Labs complete di testing of postmortem samples wey dem identify say na from Mr Aloba, and a report was issued in early April 2024.”

'We no go fit tok di result' - Lagos State DNA and Forensic Center

Di Lagos State DNA and Forensic Center don reply to inquiry if dem truly receive di postmortem result of Mohbad.

On Friday 7 June 2024, BBC News Pidgin bin send mail inquiry to di center and dem confam say dem truly send di toxicology samples to NMS Labs for analysis.

Meanwhile, di Lagos DNA and Forensic Center say dem no go fit tok di test results sake of say na ongoing investigations. Through an email reply to BBC News Pidgin, di oga of di center Dr. Richard Somiari say dem don send di results give di authority wey request for am.

“Di toxicology samples, I fit confam say we receive di samples and forward am give NMS via ITSI Biosciences for analysis.

“We don receive di results and forward am give di authority," e tok.

Wetin pathologist tok on Mohbad autopsy result

Meanwhile, Sunday Shoyemi wey be pathologist for Lagos State University Teaching Hospital (LASUTH) appear bifor di coroner magistrate court for Ikorodu on Wednesday 15 May wia im tok on di autopsy result.

Local media bin report say di pathologist say di autopsy wey dem do no gree reveal wetin cause di death of Mohbad sake of say di body don decompose bifor dem conduct di autopsy.

According to Wahab sh*ttu wey be di legal representative for Mohbad family, im further clear wetin di pathologist bin tok for court.

"Wetin e tok be say dem no sabi di cause of death and dem suppose don exhume di body within 12hours so e no go decompose bifor dem do di autops," di lawyer tok.

Di lawyer add say di pathologist refer to one certain drug wey di late Mohbad use bifor e die “but e no fit tok weda na dis drugs cause di death or not."

Lawyer sh*ttu explain say e neva see di full report of di autopsy result and di inquiry still dey go on - to begin kwesion di result wey di pathologist bring.

Mohbad autopsy report: US lab update on Mohbad postmortem sample, report on cause of Mohbad death - BBC News Pidgin (3)

Wia dis foto come from, MOHBAD/INSTAGRAM

Wetin don happun so far?

Since dem set up di coroner inquest wey dey look into di cause of death late Mohbad, na different witnesses dem don invite to come tok wetin dem sabi ontop di matter.

Meanwhile, di coroner inquest ova di death of Mohbad still dey go on.

Di Nigeria police force assure family, friends and fans of di late Nigerian singer Mohbad say dem go investigate di circ*mstances wey surround di death of di 27-year-old artiste.

Mohbad wife Wunmi Aloba bin reveal reason why her husband no ever go hospital wen im get injury for hand.

Dis na sake of how many pipo dey question why she no quickly carry am go hospital.

Wunmi appear for court for di coroner inquest sitting wey dey look into di cause of death of her husband.

She tell di inquest say e get reason why her husband hate to dey go hospital afta im don face many threat issues from im former label.

Wunmi tok say di whole fear begin from wen Mohbad make attempt to comot di record label and di time wen officers of di National Drug Law Enforcement Agency (NDLEA) bin carry am and oda record signees.

Na different witnesses don dey testify for court since di siting bin begin and e neva end.

Na Spending appear as witness last wia im tok how di fight of Mohbad and Primeboy bin happun bifor di death.

Mohbad autopsy report: US lab update on Mohbad postmortem sample, report on cause of Mohbad death - BBC News Pidgin (2024)
Top Articles
Latest Posts
Article information

Author: Annamae Dooley

Last Updated:

Views: 5740

Rating: 4.4 / 5 (65 voted)

Reviews: 88% of readers found this page helpful

Author information

Name: Annamae Dooley

Birthday: 2001-07-26

Address: 9687 Tambra Meadow, Bradleyhaven, TN 53219

Phone: +9316045904039

Job: Future Coordinator

Hobby: Archery, Couponing, Poi, Kite flying, Knitting, Rappelling, Baseball

Introduction: My name is Annamae Dooley, I am a witty, quaint, lovely, clever, rich, sparkling, powerful person who loves writing and wants to share my knowledge and understanding with you.